NA GOD by KELLI BERRI
Kelli Berri aka Kingdom Giant realeases his long anticipated Afro -gbedu single titled " Na God ". The has been an anthem to people both in Nigeria and outside Nigeria, this song has also been an open door for the artist.
Kelli Berri - Na God lyrics
Verse 1
Baba na you wear the crown for this beauty pageant
When I wan see you I no dey pass through any agent
When it comes to my matter you dey get patience
Now I believe say na you be my real parent
Came to this life free I no dey pay rent
No matter wetin Dem talk me I no send
Even when I dey dull you still dey give me sense
HOLY GHOST dey guard me like say I build fence
Opu-Tamuno I dobale for you
Everything wey you talk no be lie say na true
Anytime I want your blessings me I no dey stand for cue
Baba you don stain my white see as everywhere stew
Wetin I go give you than to write lines
This kind of love e dey scarce for this end time
Economic recession but I still dey shine
Them wan know wetin you give me wey make the boy smile
Chorus:
Who gat the juice?
Who gat the sauce?
Who dey make the people to dance along?
Shey na God....na God x4
Too Sweet, God your loving is too sweet x2
Verse 2.
Other gods no dey try,see them no reach
God you too good see na you I wan preach
If you be topic,me I carry chalk I wan teach
And if you like fair guys I go just bleach
Mallam suya God your love is too sweet
I no go brush mouth I no go use toothpick
Cus the kind of love you show me it is too thick
And if you are many it is only you I'll still pick
Everyday see your blessings embarrass me
All of a sudden,I didn't even expect it
I can't fit shout cus u give me plenty blessings
Too much love for the boy I can't express it
But if you ask me who I am,I'm a baby boy
Take you on a ride,put you in a convoy
All Benz,check the back it is Rose Royce
And if mosquito day inside I go on coil
Repeat chorus